Why we come need StaFi rDEX

Wonder Maey
3 min readFeb 28, 2022

StaFi don bring better tin wey we fit dey use our rTokens, and even if wan exchange am we fit do am for there. Dem call am rDEX. Na like exchange but na especially for StaFi rToken dem.
As StaFi bring this rDEX come, pipu don dey ask queshn say StaFi suppose dey do this one ? Shebi dey don already get many place wey we dey use take change our rTokens when we wan change am like dem curve, uniswap and the rest.
We fit even use am do market do trade, sell am abi even to stake am.
So e come be like say we need StaFi rDEX. But no be so. E get many beta tin wey StaFi rDEX go fit do.
- rDEX go make sure say all rToken dey one place for easy use.

- With rDEX, you fit use StaFi him token wey be FIS take trade the rTokens.

- Becos all dem rTokens go dey one place for StaFi rDEX pesin no go spend too much money for gas fee to take send us token from one chain go anoda chain.

- Also as you go dey use rDEX take trade ya rToken you no go dey lost part of ya rToken on top sometin wey dem dey call slippage.

- Anoda tin be say pesin wey put money for rDEX, StaFi go protect the pesin funds. How dem dey take do am? Dem go give the pesin FIS token so the pesin go take hold bodi.

- For rDEX we no go dey find how to take balance fund wey we get so dat we go fit do liquidity becos pesin go fit give fund for any rToken asset wey him want.

- rDEX don help to solve the issue wey dey occur for other project dem like low funds for the rToken, wey dey make am no dey easy to exchange rTokens for there. For rDEX liquidity go dey berekete.

- For later tins, StaFi go bring new rTokens dem and dey go upgrade rDEX so dat pesin go fit use rToken take trade rToken.

So make we dey wait for rDEX make e launch wey we for fit use am. Go sharp sharp go buy FIS wey you go use trade with rTokens dem on top StaFi Chain.

Wetin be StaFi?

Dem be DeFi protocol wey dey help pipu to see gain on top wetin dey don stake for blockchain. The tin be say before if persin don stake him coin e no dey easy to get am except e go wait for when time go reach to collect am or e go lose some coin if e no fit wait.
StaFi don change am for we blockchain pipu because now if you stake coin for StaFi app, dem go give you another kain token wey dem dey call reward token wey you go fit dey use trade and you go fit transfer am at any time.
make you visit stafi.io for more tori.

--

--