Wonder Maey
4 min readJan 31, 2022

--

WETIN STAFI BIN DO FOR DECEMBER

For December, StaFi bin bring StaFiHub ( wey dey wan to dey use on top cosmos ecosystem), dey come list rToken on top rSwap join so dat pipu wey get rTokens go fit use am trade or change am collect anoda token.
The first rTokens wey pesin fit use rSwap V1 take swap na rFIS/rMATIC/rSOL but now dey don join rATOM, rDOT, rBNB, rFIS, rMATIC, rSOL for pesin to swap am to original token on top 90% discount.

Wetin Be StaFiHub
Na StaFi chain wey go dey work for Cosmos pipu rToken. Plenty work don go for StaFiHub so dat e fo fit do the kain work wey StaFi need am to dey do.
E get many of dis progress wey happen for December.

Technical Work Dem.
- For December 8, dem upgrade the StaFi chain, now the chain fit dey compile for a beta way. Dey don even add anoda tin wey rSwap go dey do. Also the recording of rToken don dey beta.

- For December 9, dem, add rFIS join rSwap V1, so if pesin wan swap, e go get FIS on top 90% discount.

- For December 11, dem add rMATIC join rSwap V1, so pesin fit get MATIC wey dey for ETH chain on top 90% discount

-For Dec 14, StaFi come bring out StaFiHub proposal wey dem wan launch on top cosmos ecosystem so dey go fit get cosmos rTokens wey pipu on top cosmos go dey use.

- For December 16, dem add rSOL join rSwap V1, so if pesin wan swap, e go get SOL on top 90% discount.
Anoda tin be say StaFi con use him native token wey be FIS for rDEX V1 as:
a) token wey pesin fit use trade rToken
b) token wey pesin fit use as gas money
c) dem save some FIS keep for pipu wey contribute their FIS token so dat incase anything happen to am Dem go get am to give the pesin back.
d) pesin fit get the FIS token as reward if dem contribute some of their token or dem mine FIS token.

Community Work Dem.
- For December 4, StaFi been reach 30k pipu wey dey follow dem on top Twitter.

-For December 8, StaFi come bring out program wey pesin fit put token to mine dem rBNB, rSOL, rDOT for rPool.

-For December 13, StaFi come make sure say rPool get rETH/ETH mining and anybody wey do am fit go get FIS reward.

-For December 15, StaFi come give sharp explanation for how pipu wey dey stake rToken fit get beta reward.

-For December 14, all the works wey StaFi pipu bin din do for November come show face on top StaFi social media.

- For 2021, StaFi bin improve well well, dem bin do many beta things like rSwap, rPool, dem bring 8 rTokens, dem bring ways wey pesin fit get anoda token for rToken, dem increase their insurance power, dem bring StaFiHub.

StaFi Collabo

- For December 7, StaFi collabo wit Tidal t make sure say pipu wey get rETH fit use FIS & USDC on top Polygon take buy insurance. The total insurance for rETH pipu be 1million USDC.

- For December 15, StaFi boss wey be Liam Young chat wit staking reward pipu about the plans wey StaFi get and dem put am for their journal.

- For January, StaFi go still put him focus for rDEX and StaFiHub. Dem don dey do their bug bounty wey be say pesin go try the site and if dem see wetin no suppose dey there or dem see something wey dem no do well dem go report am and dey fit get reward for FIS.
So make we dey watch out for StaFiHub V1, StaFi Parachain design work, rToken app like staking derivatives index.

Wetin be StaFi
Dem be DeFi protocol wey dey help pipu to see gain on top wetin dey don stake for blockchain. The tin be say before if persin don stake him coin e no dey easy to get am except e go wait for when time go reach to collect am or e go lose some coin if e no fit wait.
StaFi don change am for we blockchain pipu because now if you stake coin for StaFi app, dem go give you another kain token wey dem dey call reward token wey you go fit dey use trade and you go fit transfer am at any time.
make you visit stafi.io for more tori.

--

--