Overall Tori

Wonder Maey
3 min readJan 31, 2022

We happy say StaFi don put him rDEX V1 for Testnet after dem don do plenty work on top am.

Wetin be rDEX
Na exchange wey dem do for rToken so dat dem go fit to dey trade dem and to dey swap dem for normal original token dem. You no need to dey go anoda chain like say Ethereum abi BSC make you for fit swap your token. Na wetin make rDEX good be dat.

rDEX get many good things:
- The slippage wey dem dey charge na small thing especially if na small abi medium token size you want swap because dem get formula model wey dem dey use. Dem call am AMM Market Model for Oyibo English.

- Dem go use StaFi FIS token take join to dey trade the rToken dem so dat dem go increase liquidity.

- If anything come happen say pesin lose because him wan give token for liquidity about security something dem go use FIS take compensate am.

- Dem fit provide liquidity or donate their token on top the two oyibo formula wey dem dey use for StaFi.
StaFi pipu dey encourage say anybody wey wan join whether na to try the app abi na developers wey wan test the rDEX say dem dey welcome Dem. Dem don also keep awuf for pipu wey fit find something wey dey no do well or something wey no suppose dey for the app make them report am. Dey go get awuf FIS.
You fit browse am for here:
https://commonwealth.im/stafi/proposal/discussion/2776-rdex-v1-solutionan-amm-dex-for-rtokens

Bug Awuf
StaFi don submit their rDEX to pipu wey their work na to dey check things like dat. But dem also give chance for their community pipu to check whether Dem fit see something wey no suppose dey the program make dem for fish am out.

All the testing whether na function testing abi code testing dey start from January 18 go reach February 17, 2022.
check this link if you wan follow do function testing:
https://bit.ly/328ahEq
For code testing make you check this link:
https://github.com/stafiprotocol/stafi-node/tree/rswap/node/pallets/rdex
Wen you don see any bug you go report am to support@stafi.io . Awuf wey dem dey give pipu wey their report na true true na from 10 USDT to 1000 USDT for FIS token size.

Wetin be StaFi
Dem be DeFi protocol wey dey help pipu to see gain on top wetin dey don stake for blockchain. The tin be say before if persin don stake him coin e no dey easy to get am except e go wait for when time go reach to collect am or e go lose some coin if e no fit wait.
StaFi don change am for we blockchain pipu because now if you stake coin for StaFi app, dem go give you another kain token wey dem dey call reward token wey you go fit dey use trade and you go fit transfer am at any time.
make you visit stafi.io for more tori.

--

--