Wonder Maey
2 min readFeb 28, 2022

--

E don tey small wey StaFi don dey talk about StaFiHub say e wan bring am come. So wetin we wan discuss today be say: shey we need StaFiHub like dis so ?

Wetin be StaFiHub
StaFiHub na wetin StaFi wan use to take control Cosmos token dem as be say their token don dey many and e sure say dem go need rTokens for dis their token dem.

StaFi go also use StaFiHub take open way for pipu wey dey build application for blockchain make dem build the kind of StaFi own so StaFi do use dis StaFiHub take accommodate dem.

So as many tokens go dey come out for cosmos ecosystem, StaFi go don use StaFiHub take ready for dem, dey dish out their rTokens.

Anoda tin be say pipu go dey way go give go ahead for StaFiHub. Dem dey call dem validators. These validators na StaFi pipu go select dem base on some kain qualities. Dem dey do dis one so dat the network go dey secured and e go work well well.

StaFiHub go dey relate with StaFi Chain so pesin go fit dey move him token for StaFi Chain go StaFiHub or from StaFiHub go StaFi Chain.

StaFiHub go stand kampe on top Cosmos SDK. Na developer gramma. Na wetin many pipu wey do app for blockchain dey use . The Cosmos SDK dey work well well. And e go dey easy to use am becos StaFi wan use StaFiHub on top Cosmos ecosystem.

Wetin be StaFi

Dem be DeFi protocol wey dey help pipu to see gain on top wetin dey don stake for blockchain. The tin be say before if persin don stake him coin e no dey easy to get am except e go wait for when time go reach to collect am or e go lose some coin if e no fit wait.

StaFi don change am for we blockchain pipu because now if you stake coin for StaFi app, dem go give you another kain token wey dem dey call reward token wey you go fit dey use trade and you go fit transfer am at any time.
make you visit stafi.io for more tori.

--

--