E Beta make you use StaFi stake ya token

Wonder Maey
3 min readMar 30, 2022

Wen you get token wey you wan dey profit form e good make you for stake am. To stake am mean say you go follow lock am wit oda pipu ow for pipu wey am plenti dem dey call dis kain pipu validator and everyday as you don put am there na so your gain go dey increase.

E get some kain wahala wey dey commot from dis kain tin. We go talk about the wahala and we go talk how StaFi dey take prevent am.
As pipu dey stake token dat token don follow do security for the network wey get dat token. But e come still mean say pesin no go fit use dat token take do normal tin wey dem for fit use am do like to trade, do borrow borrow and oda tins like dat except say dem wan commot am say dem no stake again but dem go lose their staking gain.

StaFi no go allow dis kain tin make e happen, na him make dem give pesin rToken wey the pesin go dey fit dey use dey do tins like trade, invest, do borrow borrow and everytin like dat.

Wen pesin stake him token e go get time wey dem go lock the token and the pesin no go fit use him token. If anytin come happen like say price come change, the pesin go carry gbese but if pesin use StaFi e no go too worry becos as e be say dem get rToken wey the pesin go dey take do trade, borrow borrow and also to take invest, e go use dat one take hold bodi.

Anoda tin be say StaFi also don check the pipu wey dey do validator for him token. Validator na the pipu wey dey kip the token wey pesin dey stake take follow secure the network. StaFi make sure say dis pipu get the unnecessary tins wey validators must get make story wey touch no go enter wen pipu come stake wit dem for on top the chain. Becos StaFi dey very interested for him pipu protection and e wan make dem dey happy as dem dey use him platform.

WETIN BE STAFI

Dem be DeFi protocol wey dey help pipu to see gain on top wetin dey don stake for blockchain. The tin be say before if persin don stake him coin e no dey easy to get am except e go wait for when time go reach to collect am or e go lose some coin if e no fit wait.
StaFi don change am for we blockchain pipu because now if you stake coin for StaFi app, dem go give you another kain token wey dem dey call reward token wey you go fit dey use trade and you go fit transfer am at any time.
make you visit for more tori.

Website: www.stafi.io
rToken App: https://app.stafi.io
Twitter: @Stafi_Protocol
Telegram Chat: https://t.me/stafi_protocol
Telegram Announcements: https://t.me/stafi_ann
Discord: https://discord.com/invite/jB77etn
Forum: https://commonwealth.im/stafi

--

--